Loading...
  • Slide 1
  • Slide 1

Overview

World Athletics rejects Favour Ofilis switch to Turkey

Di plan of Nigeria track queen, Favour Ofili to switch di kontri wey she go dey represent from Nigeria to Turkiye no work at all.

For September 2025, Favour bin announce say she don port from Nigeria to Turkey.

E bin mean say for big world sporting events like Olympics, World Athletics na Turkey she go dey represent on di international stage.

But di plan no work as di World Athletics Integrity Unit reject her international transfer from Nigeria to Turkiye.

For di document wey carry di decision wey di panel wey dey in charge of international transfer bring out, dem tok say "Di Application by di Athletics Federation of Turkiye (TAF) for Favour Ofili (di "Athlete") to transfer allegiance from Nigeria to Turkey no dey approved."

E mean say di 23 years old go continue to represent Nigeria for international events.

Favour wey dey run 200 metres for Nigeria bin no happy wit di Athletics Federation of Nigeria (AFN).

Wen she bin announce her switch to Turkiye, she bin tok for her post last year say, "I dey proud say I don represent Nigeria for many years in highly successful way! I don win SIX gold medals, TWO silver medals and TWO bronze medals in championship meets and 200 meter Olympic finalist while experiencing di biggest disappointment from AFN and NOC towards me".

Credit: BBC